RE: Sam's Hangout #75- “ WHAT ARE YOU LISTENING TO?”

You are viewing a single comment's thread:

Dem don dey add Sunday sef for the Owambe O.

I have some house chores to do today.

Tomorrow, I will be attending a wedding. Let me sef go and ganusi. He don tay.

@beckyroyal @ellizy @justfavour @treasuree

What are your plans for today?



0
0
0.000
41 comments
avatar

Wedding on a Sunday? Rare but those kind of weddings are always Odogwu and Achalugo

0
0
0.000
avatar

Most people don dey join in now o.

0
0
0.000
avatar

Seriously plenty people are now doing their wedding on Sunday

0
0
0.000
avatar

Na so. How else dem go dey reduce people wey go wan do "mogbo mo branch".

0
0
0.000
avatar

Wondering who dey hold wedding tommorw bring Sunday

0
0
0.000
avatar

Plenty people don dey do am now my Queen.

0
0
0.000
avatar

Yes oo tomorrow I get walimoh

0
0
0.000
avatar

Abeg send location na. Help a sister.

0
0
0.000
avatar

U dey go ijesha, me dey go ijanikin. You fit branch if you quick return sha lozzxx

0
0
0.000
avatar

No. Tell the Alfas make dem wait for me. When I come back dem go start the Walimah.

0
0
0.000
avatar

Oya na, Sha invite me o. I will attend as long as it is within Lagos State 😁

My Saturday was spent eating chicken that I was given from a mset-up yesterday. I was served fried rice and chicken but I ate the rice and kept the chicken inside a black nylon so that I can enjoy myself today.

I ate the chicken with a cold bottle of Pepsi, then I slept jejely like a new born babe😂.

Wave Media

0
0
0.000
avatar
(Edited)

Chaiii see enjoyment. God When?

Make una dey invite me for all this outing na. Help me eeeeee.

0
0
0.000
avatar

😂😂😂

Your network was acting up yesterday so the call couldn't connect and I no get magic mirror to call you o

0
0
0.000
avatar

See excuse. Na kuku Airtel give you chance to give me the excuse.

You sef for join those DC super heroes wey dey transport to another universe na.

0
0
0.000
avatar

I call Thor but he said he was on vacation,so him no answer me.

Sorry ehn 😂😂

0
0
0.000
avatar

Green Arrow nko?

You for just hang yourself for the tip of hin arrow he go just catapult you reach my side.

0
0
0.000
avatar

Green arrow wey go dinner party wey Dem drug him wine, mtchewww abeg look for better superhero

0
0
0.000
avatar

Oya allow Batman. Him papa get money o.

0
0
0.000
avatar

Batman go look down on me because me i be ajekpako babe 😂😂

0
0
0.000
avatar

Never say never. He'd probably sweep you off your feet 😉😉😉😉😉

0
0
0.000
avatar

See enjoyment ooo. This chicken is looking so inviting. Ah swear

0
0
0.000
avatar

I just remembered that I saw @abdul-qudus and @goldenprohect in my dream. It's like they were begging me for chicken. Too bad I already ate it all.

0
0
0.000
avatar

😃😃😃😃😃 inside this economy na him you dey chop alone.

I say you wicked seh

0
0
0.000
avatar

No be only you don call me wicked even @abdul-qudus don call me wicked before but if you have seen the movie titled wicked, then you will know that I ain't wicked 😂😂😂

0
0
0.000
avatar

For your mind now, you be elphaba?

Na Glinda you be.

0
0
0.000
avatar
(Edited)

No letter G for my name 😝😝

0
0
0.000
avatar

Na your oda name be that.

Becky Glinda.

0
0
0.000
avatar

So you want do new naming ceremony for me abi?

No wahala, just buy malt like 4 cartons and 10 cartons of biscuit, so that we go share for everybody for this hangout.

Then I go begin bear Becky Glinda 😂

0
0
0.000
avatar

As how? Name wey dem don give you since you small.

How many ikomo you want make dem do for you ehn, fine girl.

0
0
0.000
avatar

My mama no know that name o. Na oyibo name biko

0
0
0.000
avatar

Share the location of the reception hall. I need to eat better rice and chicken today.

0
0
0.000