Our Wife Don Enter! Iwo Wedding Na Pure Enjoyment

avatar
(Edited)

Hello my people! As I don tell una before say my elder brother go do traditional wedding, make I gist una how everything go. We travelled all the way to Iwo in Osun State for the ceremony, and I swear, the whole experience na something I no go forget in a hurry.

We comot from ibadan early this morning. The journey long but sweet, because we dey inside convoy and our bus dey play better Fuji and Afrobeat. Some of my cousins just dey dance inside motor. We even stop for roadside to buy gala and drink, and the road no too bad. We reach Iwo around before 12 noon, and as we land, the bride family welcome us well,That kind welcome wey dey touch your soul,

Na since friday morning,Everybody don wake up early, preparations full ground. The women dey cook from morning, and you know Yoruba traditional marriage no complete without jollof rice, amala, ewedu, gbegiri, assorted meat, small chops and all those things. The aroma alone fit wake dead body 😅.

The bride people come with full swag. Their aso-ebi dey shine like sun. Our own colour na purple and lilac color, and we really show. As per Yoruba tradition, the groom (my brother) and we his people go lie down flat “dobale” to greet the bride’s family. I won follow lie down too o,but as per say i be woman i for join then and lie down cuz me and my brother we be besties😀

The MC dey speak Yoruba-English mix, dey crack jokes, dey hail families. Everybody dey laugh. Then the bride come out kai! She fine like 10 people join. She do “mo mi n mo e” (wine carrying) to my brother, and as she kneel down give am, na shout everywhere. Our in-law dance enter our side, and we welcome her with open arms. Our wife don enter house!

When time reach to chop, na war zone 😂. Food everywhere. You go chop tire. Drinks nko? From Zobo to Chapman to soft drinks, even small Hennessy dey corner. And no be say food finish o. People pack takeaway like say na party rice competition.

Then the dance begin. Fuji band enter with their talking drums. All those uncles and aunties begin spray money, especially when my brother and him new wife dey dance. Even mummy wey dey do like say she no dey hear music before, begin shake body. Me too, I no dull. I scatter floor with steps!

By night, everybody don almost lose voice. We snap pictures, greet long-time family and friends, and just dey thankful say everything go well. No fight, no wahala, only pure joy and love.

As we dey return back to base, my heart just dey full. The wedding sweet, we bring our wife come house, and memories full my head. Now I dey wait for naming ceremony o 😄.

Thanks for stopping by and reading my story
With Love🧡💜💛
Hamidu Yetunde



0
0
0.000
5 comments
avatar

View or trade LOH tokens.





@royaluy, You have received 1.0000 LOH for posting to Ladies of Hive.
We believe that you should be rewarded for the time and effort spent in creating articles. The goal is to encourage token holders to accumulate and hodl LOH tokens over a long period of time.
0
0
0.000
avatar

Wow nice to hear from you were is my own rice jolly and chicken 🍗 🐔 am waiting for it ma I hope you too dance sha 💕💯❤️

0
0
0.000
avatar

Chai you come enjoy only you, you no invite me 👀

0
0
0.000
avatar

Smile....so sorry about that love

0
0
0.000
avatar

[@PowerPaul:]

Hey! Because of your participation in the @CryptoCompany community and your participation in the "Banner for Boost" campaign you received a vote from your CryptoCompany and its trail! Thank you & Hive a great day!

Please don't vote on this comment as a thank you, because this comment is not really POB. If you like to thank me for my service & support development of more services, please think about a small HP delegation to @PowerPaul or visit my blog & leave a vote on a posting there. Thank you very much!
Recent posting from @PowerPaul or the CryptoCompany network:
[ENG/DEU] NOT a Saturday Savers Post: 59 (or 350 or 500?) HP in Week 30 2025 | 1,111 HP Needed for 2... [ENG/DEU] #FunkyFrameFriday | Musical Photo Contest Round #11 | Vote for Your Favourite Music Relate...
0
0
0.000