RE: Sam’s Hangout #82 -”STORY TIME”
You are viewing a single comment's thread:
This is one of the stories I heard when I was little. We lived in a compound filled with people and children so most times at night we gather to sing songs and tell stories and this was one of it but then I am putting it in pigin English. Enjoy!🙃
One day, Tortoise hear say Lion dey do big birthday party for forest. Dem say food go plenty, rice go reach heaven, and jollof aroma don already dey trend for bush WhatsApp group.😅Tortoise wear him best agbada, spray perfume wey fit wake dead mosquito, and waka go the party. But gate people stop am.“Who invite you?”Tortoise smile, “Me? I invite myself. I be VIP - Very Important Pikin!”😏Dem pity am enter.
As food reach table, Tortoise shout, “Make una no rush o! Table manners first!” but before anybody blink, na him spoon first enter cooler.He chop rice like say tomorrow no dey. Meat wey suppose reach ten animals, disappear like rapture.
Monkey look am say, “Tortoise, you no dey shame?”Tortoise reply, “My brother, hunger no get respect for shame.”😂 (ahbi no be so?)🤣
After food finish, Lion announce, “Anybody wey no bring gift go wash all the plates.”
Na so Tortoise freeze ooo....🤣 Dem hand am sponge and bucket. Na so our oga wash plates till night, singing, “If I know, I for carry pure water come as gift.”
Uwoooh!!😂
Oya @hiventhusiast @careergirl @blackbird44 @daverick
Mak una come yard una storey😂
Lol as in. Make him use the food he chop watch plate. A win for win ,abi how them dey talk am 🤣😂
😂😂😂yes ooo
E think say e wise😂
Over sense wan kill am 🤣
E no pass like that 🤣
Tortoise don suffer in this life
Hahahaha.😂😂
Mama, no be small thing oo
Tortoise with different different version of script 🤣🤣🤣
I dey tell you 😂😂😂
first time his wisdom failed him 😆 Mr Sharp guy ... if tortoise was to be a human he would be Sabinus 😆 🤣 😂 😹
Hahahahha....so true ooo😂😂
🤣🤣🤣 see finish
yes na 😆 🤣 😂
🤣🤣🤣
Lol
Sense don meet sense
Tortoise sense fail am😂
I dey tell you
😂😂😂
I wonder what will be his next moves
Honestly ❤️
Thanks for following, hope you see more of your blog post ❤️
Yh
Definitely
Hehehehe...e think say e wise
Swrs
Omoo why all these stories dey around tortoise. Mr. Tortoise don too suffer. Chaii 😅
Shege wey him eye don see no be for here
No be small oo. Na now I understand him bald head 😂
And foodie behaviour because guy man needs food for strength
Lol. No be lie.
👍
No be small thing oo.😅
Smiles 😁
Am not sure there is anyone who wouldn't be told the tortoise story while growing just that it's in different scripts.
But I love this story 💯
Thank you, ma. Everyone must have a Tortoise story to tell
Definitely.
You are most welcome ma 😊
Na why you tag me cus I love eating but doesn't like washing the plates
You didn't have to expose me like this na😭😭
How I wan take convince person now make Dem for allow me eat without condition 😡
Inwang ..😂😂😂
Na you expose yourself oo😂
🤣🤣🤣🤣
This bad character won't lead you anywhere
Stop casting your friends 🥰🥰🥰🥰