RE: Hive-Naija Weekend Engagement #70- βLOVE VS FINANCIAL SECURITY
(Edited)
You are viewing a single comment's thread:
I will tell for you. Be like meeting dey today sef π
No na, una no suppose avoid dem. Stay and build their empire with them so dat they can say βshe was with me when I had nothingβ ππ
You gerrit abi...
0
0
0.000
Lai Lai, for where that one dey happen? Omo bro e don tey ooo. No be today again or dis generation.
Most men will need a woman t build and after that, Dem go dump the woman go look for young chikito.
Me I no be builder of destiny and Dem no write helper for my forehead. If I do am, then it means that the guy must lead the way first ππ
Say na chikito π π
E dey happen sha...
Lol, but shey una suppose be helpers na...abi how ne sef. Na so e suppose be na, na him go lead. Na why behind every successful man, dem talk say woman dey, abi na π
No ooo, that one na old school proverb.
It is now beside a successful man is a good woman ππ
But be like if you catch the man you build something with one young chikito, dat chikito go regret why she come dis life oo π
No now, I'm not that petty.
Na the man go collect wototo. I go make sure the empire crumble but only after giving slices of it to my childrenππ
The man wey go try that kind thing with me self, Dem never born am. So I'm safe ππ
Abeg help me greet Dem broke guys for the meeting o ππ
π
For clarity sake sha, I be guest minister on a mission to bring dem salvation from poverty...ayam not a member of the association π
I know... don't worry. No one is calling you broke, Mr minister ππ