Make person no first craze before consistency go begin pay off

avatar
(Edited)

My people, una well done oo!

Many things don happen wey I suppose don write but motivation no come dey.

You see this thing wey Oyibo dey call consistency, e no get manual. I don finally begin dey understand.

Make I no lie, e no easy. Especially when you be Creative wey dey pour your heart inside your work, and you start dey doubt yourself.

E fit even reach stage wey your brain go make you start dey reason, “Abi make I just rest small?”

But truth be say, consistency go first test your mind before e reward your hand. If you loose guard, you go begin dey question your passion, your commitment, your reason for starting.

No give up! You go surely reach stage wey people go begin dey wonder, “How im take do am?”

  • Dem no go see the nights wey you no sleep.
  • Dem no go sabi how many times you almost give up.
  • Dem no go count how many drafts, rejections, or ideas wey no fly.

Dem go just see results, come assume say na luck. 🤷🏽‍♀️

No worry, your results go make dem look pass Lucas.👀

This post na for my people wey dey grind… even when e no dey make sense.

One day, you go look back talk, ”So na this small thing I dey do wey God don take carry me enter better level.”

Until then, craze small but no give up.

Even Noah for Bible take 100 years build ark when e no rain. He just dey follow Baba God’s instruction. People dey laugh am, but he no stop. That one na mad consistency. So, na your own go come different?


I salute una🫡



0
0
0.000
5 comments
avatar

View or trade LOH tokens.





@annytheexplorer, You have received 1.0000 LOH for posting to Ladies of Hive.
We believe that you should be rewarded for the time and effort spent in creating articles. The goal is to encourage token holders to accumulate and hodl LOH tokens over a long period of time.
0
0
0.000
avatar

I go lie for you...Sometimes be consistent can tiring most times... Sometimes consistence go wait make your mind first de before e go show...e no easy ajeh

0
0
0.000
avatar

Lol, who in God’s name are you?😂😂😂

See how you spewed facts in this post and in pidgin? My darling how you run am oooo

I genuinely enjoyed this and I am sorry you literally got nothing for it, We moveee🫂🫂

0
0
0.000
avatar
(Edited)

Thank you, my sister! Life no balance normally 😅

We continue meuving!

0
0
0.000