School Life Sweet, But Exam Na Wahala For Me
If you never hear am before, now you need to hear with experience say School life dey sweet, but na exam dey spoil am?" School life na cruise, laughter, play, gist, new friends, even crush! But once exam they approach or dey show face everything go change sharp-sharp.
Normally, I dey enjoy school, but once exam time dey near, I go just begin to fear, pressure go increase wahala full head. I no go play like before, even my behavior go change na so I go dey gentle. Na so I dey carry my books reading mode activated, especially when everywhere don calm. I like to read alone that time no noise, just me, my snacks.
But make I no lie, some courses like Mathematics and Chemistry dey show me pepper. Dem no dey enter my head fast. So, for those ones, I dey link up with friends. Group reading dey help small because colleagues will explain what I don't understand.
I am very use to reading close to exam and revise well. I no too sabi cramming, I prefer understanding wetin I dey read. I dey take breaks, chop small snacks, and try sleep well. Na my own way to survive exam stress like that Iam used to.
But make I talk true we students get our own tricks. Some go read only past questions, some go dey look for expo. Some dey cheat with small paper, some go dey eye person work like say dem be invigilator. After exam, fight go burst because of one answer wey somebody insist say na correct. "Na 22!" "No be 22, na 23.5!" Argument go scatter like say na JAMB marking center. Na that thing dey angry me pass, Exam that I have done and submitted still started arguing over it.
At the end, we all just wan pass. But truth be say, everybody get him own style. Some dey read early, some dey wait till last minute. Some dey read alone, others na group. The koko be say, no matter the method, make we dey honest, work hard, and no forget say exam na just part of the journey e no be the whole life. Just do what fit you the best.
So as exam dey come, and go go no panic. Find wetin work for you. Whether na night reading or group study, just try your fit and if na Math and Chemistry be your challenges like me, you no dey alone.
@davingson @julie100 @ harmony01 to join this prompt.
Congratulations @amazing23! You have completed the following achievement on the Hive blockchain And have been rewarded with New badge(s)
Your next target is to reach 50 upvotes.
You can view your badges on your board and compare yourself to others in the Ranking
If you no longer want to receive notifications, reply to this comment with the word
STOP
Check out our last posts:
[@PowerPaul:]
Hey! Because of your participation in the @CryptoCompany community and your participation in the "Banner for Boost" campaign you received a vote from your CryptoCompany and its trail! Thank you & Hive a great day!
Recent posting from @PowerPaul or the CryptoCompany network:
by @cryptocompany
by @cryptocompany
by @powerpaul